Eastern Cape protest: Coronation of Chief Solomon Ogbonna Eziko Igwe Ndigbo Na East London cause protest for Eastern Cape – BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, SABC Screengrab

Read am in 4 mins

Nigeria govment don ask dia citizens wey dey live for South Africa to limit movement and avoid public gatherings as tensions remain high.

Di Nigeria High Commission for Pretoria wey issue di advisory on Monday night warn dia citizens to exercise following di violent protests wey break out for di Eastern Cape city of KuGompo, previously known as East London.

According to reports, na di coronation of one Nigerian community leader Solomon Egbonna Eziko, one Igbo national wey dey recognised by members of di local diaspora as “Igwe Ndigbo Na East London” trigger di protest.

Chief Solomon Ogbonna Eziko bin collect title as di Igwe Ndigbo Na East London two weeks ago.

Na various civil society groups and political parties organise di protest. Di demonstration bicom violent afta one of dem claim say one foreigner stab am during di demonstration.

Di angry protesters burn shops wey belong to both foreign nationals and South Africans and set at least 10 vehicles on fire. Di protesters force businesses to close, and police use rubber bullets to disperse crowds.

Police tok say dem don begin investigate di mata, although dem neva make any arrest.

Di mayor of di town Princess Faku don condemn di violence. “We support di march becos na part of di efforts of defending our sovereignty, but we no tolerate violence. Violence no dey solve problems…e dey very sad say dis kain important march later turn into violence and chaos”.

Provincial authorities and cultural experts don also condemn di coronation as unlawful and violation of customary protocols.

One meeting between di high commissioner of Nigeria and various South African government representatives dey scheduled to take place on 8 April.

Wetin we know

For videos wey don dey spread on top social media, e show say kasala don burst for di protest wey lead to di burning of private property.

Di coronation bin take social media by storm as one joinbodi of traditional leaders reveal say e dey against di customs to claim Kingship ova area wey alreadi get traditional leader.

According to di Chairman of di Eastern Cape House of Traditional and Khoisan Leaders (ECHTKL), Nkosi Mpumalanga Gwadiso, e tell loclal tori pipo, TimesLIVE say di area dey under di amaRharhabe kingdom wey dey di hand of King Sandile.

Di kontri public broadcaster, SABC, bin report say na di KuGompo city NGOs and di Eastern Cape residents bin gada for road to protest di mata and even at den di department of of Cooperative Governance and Traditional Affairs, COGTA and di Buffalo Municipality don comt to condemn di mata.

Prince Xhanti Sigcawu wey come from di Amathole House of Traditional Leaders call for di deportation of pipo wey get dia hand for inside di so-called coronation as e tok say, “I dey vex say Nigerians fit come hia and claim say dem get king for hia”.

According to di Eastern Cape co-operative governance and traditional affairs MEC Zolile Williams, e say im department hand no dey inside di so-called installation of king by foreigners of di province.

All dis one dey come as di Nigerian Union for South Africa bin try clear di air on wetin di crowning of Nigerian King for East London actually mean.

Dem to say di move na just ceremonial title wey dey given to preserve du culture of Nigerians wey dey live for abroad and no go affect di local establishment of di host kontri, according to tori wey SABC bin report.

Di NUSA president Nwobi Smart bin dey reported say e tok say, “dis Cultural Ambassafor goo look to be di middle man between local authorities of di Nigerians wey dey stay for dis areas plus including di middle man for di embassies or consulate in case say sometin sup wia dem find say Nigerian nation don commit.”

E come add say, “na dis cultural ambassador wey dem go call to chook mouth if attacks dey inside di locality.”

https://www.facebook.com/bbcnews
www.bbc.com

Scroll to Top